'Dem comot my hip sake of Tuberculosis of di bone' - Survivor
- Author, Adesola Ikulajolu
- Role, BBC News
- Twitter,
- Reporting from Lagos
Ajibola Bamgbose dey six years wen her mama begin dey notice some changes for di way she dey waka and temperature for leg.
E first start like somtin wey dey common to small pikin but her mama no rest until she carry Ajibola go hospital.
Ajibola tell BBC News Pidgin how she take discova say her hip don damage sake of Tuberculosis of di bone.
Afta several hospital appointments, Ajibola mama hear from health officials say nothing dey do her daughter but she still dey see symptoms wey no dey well for her daughter leg.
Dis struggle bin kontinu till Ajibola reach 14 years old and dem carry her go anoda hospital for test and afta plenti tests, dem tell her say she get Tuberculosis of di bone.
Ajibola na graduate wey don begin to push her career as conflict resolution specialist to help pipo and organisations resolve conflict. But she still face stigma wit di bacterial wey damage part of her body.
For about 13 years (14 years to 27 years), Ajibola dey use medication to fit fight dis Tuberculosis of di bone, but sadly, di bacterial don damage her hip.
At 27 years old, Ajibola do surgery wey lead to di total replacement of her hip wit artificial one. Dis na becos di bacterial don damage some part of her hip.
Currently, Ajibola dey recova from di surgery wey she do to replace her hip but di journey no too easy for her.
According to di World Health Organisation, Nigeria dey among di number of kontri wit di highest number of Tuberculosis infection.
Video: Idara Monday