'Dem call me river child becos of my deformity'
Enyonam na woman wey dey live wit disability and don fulfil her dream to raise pipo especially children wey dey also live wit disability.
She don retire from teaching afta 30 years wey she begin dey concentrate on raising children wit disability all by hersef.
Enyonam bin dey teach di children to dey do tins on dia own - to fit take care of diasef.
Though she still dey face stigma wit her disability but she say dat neva go pull her down.
She wan make odas see pipo wit disability as normal human being.
Filmed and produced by Idara Monday.