Trump wan sama movies wey dem make outside US 100% tariffs
- Author, Peter Hoskins
- Role, Business reporter
US President Donald Trump say im go hit movies wey dem make for foreign kontris wit 100% tariffs, as e dey round up trade disputes wit nations around di world.
Trump say e dey authorise di US Department of Commerce and Trade Representative to start di process to impose di levy becos America movie industry dey die "a very fast death".
E blame a "concerted effort" by oda kontris wey dey offer incentives to attract filmmakers and studios and e describe am as a "National Security threat".
E say dis fit spell a "knock-out blow" to di industry, one union warn, say filmmakers for years dey comot Hollywood for destinations like di UK and Canada to search for lower costs.
Trump tok for im Truth Social platform: "E dey in addition to evritin else, messaging and propaganda!"
"WE WANT MOVIES WEY DEM MAKE FOR AMERICA, AGAIN!"
US Commerce Secretary Howard Lutnick respond to di announcement, e say "We on am".
But di details of di move dey unclear. Trump statement no say weda di tariff go apply to American production companies wey dey produce films abroad.
Several recent major movies produced by US studios dey shot outside America, including Deadpool & Wolverine, Wicked and Gladiator II.
E dey also unclear if di tariffs go apply to films on streaming services, like Netflix, as well as dose wey dey show for cinemas, or how dem go calculate am.
Di founder of European cinema chain Vue, Timothy Richards, question how Trump go define a US film.
Speaking to BBC Radio 4 Today programme, e say: "Na wia di money come from? Di script, di director, di talent, wia dem shoot am");